Motherland

Album cover art for "Motherland" by Sound Sultan

Sound Sultan - Pop

Motherland

1 Plays

Duration: 5:22

View ArtistView Album

Lyrics

Oh, ajo o dabile eh No matter where you go, make you try come back area o Area o Na Naija Ti ode ba ti le pada wale o Wale o uh o How I wish say I fit reach you anywhere you dey eh You dey eh Far away eh That one no say make you dey bone area o Motherland iyo (na your area) Chinedu somebody borrow you ego Make you take carry go Chicago Remember Nnamdi sell him car So you go go America All these people wеy been dey raise you Still dey stay for facе me I face you You promise say you no go fashi them Every other month you go dey tachi them Hillary wey you been promise to marry Still dey wait, oh boy she don tarry When she go see you, na inside ovation You marry oyinbo from another nation Use mago mago, get dough Now your oyinbo wife don know Next thing you know, she don go report you Wetin you know, them don deport you How I wish say I fit reach you anywhere you dey eh You dey eh Far away eh That one no say make you dey bone area o Motherland iyo (na your area) Ajo o dabile eh No matter where you go, make you try come back area o Area oh oh Na Naija ah Ti ode ba ti le pada wale o Wale oh uh You been say na 1 year E come turn to 2 years E don go for 7 years But you dey serve 11 years Even when your papa die Plus the tears your mama cry Bayo for Chicago, them dey miss you for Okoko o Biodun for Canada Your mama still dey wonder Igba wo lo to ma pada o Remember for Naija, u get iyawo Ko da bi ile, ko da bi ile, ko da bi ile e, ko da bi ile, ko da bi ile e, ko da bi ile e, ajo o ma da bi ile e How I wish say I fit reach you anywhere you dey eh You dey eh Far away eh That one no say make you dey bone area o Motherland iyo (na your area) Ajo o dabile eh No matter where you go, make you try come back area o Area oh oh Na Naija ah Ti ode ba ti le pada wale o Wale oh uh You say you go call o Everybody wait tire for your call Ote o, why you go like so o From Germany to carry coco enter Yankee But then coco burst for your belle Rest in peace iyo Fly away, I come wonder if one day you fit to come iyo Your papa land iyo, I understand say you dey so far away You gone a long long way from home, long long way from home, long long way from home, long long way eh eh Yes o Ajo o dabile eh No matter where you go, make you try come back area o Area oh oh Na Naija ah Ti ode ba ti le pada wale o Wale oh ooh oh How I wish say I fit reach you anywhere you dey eh You dey eh Far away eh That one no say make you dey bone area o Motherland iyo (na your area o)

Rate this song

Rate this song

0/5.0 - 0 Ratings

5
0.0% (0)
4
0.0% (0)
3
0.0% (0)
2
0.0% (0)
1
0.0% (0)

Loading comments...

Credits

Writers
  • Sound Sultan