Area (Acoustic)

Album cover art for "Area (Acoustic)" by Sound Sultan

Sound Sultan - Pop, Acoustic

Area (Acoustic)

2 Plays

Duration: 5:35

View ArtistView Album

Lyrics

Yeah Sound Sultan, Naija Ninja Hiya! Kennis You know how we dey do am This one na go all my brothers wey don dey go outside Naija Wey don ja comot for Naija Always try to dey look back because there's no place like home Yknawmean? Yoruba man tell me say ajo o dabi ile And na true men Check this out Oh oh Yeah yeah yeah yeah yeah oh Eh Ajo o dabile eh No matter where you go make you no forget area o Area o Na Naija Ti ode ba ti le pada wale o Walе o oo uh o How I wish say I fit reach you anywhere you dеy eh You dey eh Far away eh That one no say make you dey bone area o Motherland iyo na your area Chinedu somebody borrow you ego Make you take travel go Chicago Remember Nnamdi sell him car So you go go America All these people wey been dey raise you Still dey stay for face me I face you You promise say you no go fashi them Every other month you go dey tachi them Hillary wey you been promise to marry Still dey wait o' boy she don tarry When she go see you na inside ovation You marry oyinbo from another nation Use mago mago get dough Now your oyinbo wife don know Next thing you know she don go report you Wetin you know them don deport you I wish say I fit reach you anywhere you dey eh eh eh You dey eh eh eh Far away That one no say make you dey bone area o Motherland iyo Ajo o dabile ee No matter where you go make you no forget area o Area o Na Naija Ti ode ba ti le pada wale o Wale o You been say na 1 year E come turn to 2 years E don go for 7 years But you dey serve 11 years Even when your papa pai Plus the tears your mama cry Bayo for Chicago Them dey miss you for Okoko o Biodun for Canada Your mama still dey wonder Igba wo lo to ma pada o Remember for naija you get iyawo Ko da bi ile Ko da bi ile Ko da bi ile e Ko da bi ile Ko da bi ile e Ko da bi ile e Ajo o ma da bi ile e How I wish say I fit reach you anywhere you dey brother meh You dey eh Far away That one no say make you dey bone area o Motherland iyo You say you go call Everybody wait tire for your call Rote o, why you go like so o? From Germany, to carry coco enter Yankee But then coco burst for your belle Rest in peace You fly away How come one day wey fun dey you fit come back o Your papa land o I understand say u been so far away Long long way from home Long long way from home You got a long long way from home Long long way from your papa land Ajo o dabile eh No matter where u go make you forget area o Area o Na Naija ah Ti ode ba ti le pada wale oh oh oh oh oh yeah Sound Sultan Naija Ninja We doing it All my brothers in the West All my brothers in the East North South You know how we doing it And all these people wey dey rule us Make una try make Naija sweet So that people go dey come back home Make we get water, light e.tc Respect Kennis Music Peace out to you Now we doing it Kennis Respect, respect, respect All my people in the house

Rate this song

Rate this song

0/5.0 - 0 Ratings

5
0.0% (0)
4
0.0% (0)
3
0.0% (0)
2
0.0% (0)
1
0.0% (0)

Loading comments...

Credits

Writers
  • Sound Sultan