Pirated Copy Intro (Skit)

Lyrics
Eh 2shotz my guy Eh sule (wetin dey now) Sole the sole Ah whats up now, I dey oh Omo congratulations oh You don finally clock the whole album project Wetin go happen men As per the album abi (eh whats the levels) Eh I go try reach alaba now you know See whether I fit run things With one of those guys Make dem drop some kind kishi At least before dem pirate the album You know that kind thing Oh okay, okay, okay Eh you don dey go now abi Eh I won reach (make I follow you now) Eh no cool down I go go alone I go cool down Shebi you dey go check that your chick Eh eh, but it no matter No no no worry, I go go alonе No worry When I come back I go holla you At least I fit flash you tеxt Make you call me oh Eh dey go dey go (you go shack me oh) Dey go dey go I go call, I go flash you text no worry Try call me oh I go call you no worry I dey go, I dey come No shaking sir, I believe you Alright later men Nna bros Eh 2shotz my man how you dey now Happy New Year Nna same to you Eh hen wetin dey now Bros I bring new job My album don, I don finish am Eh your new album My new album Eh eh correct mm bring it now, lets see now Bring it, cool down first make we talk price now Bring it now, nna cool down ah ah Your are always in a hurry Cool down make we talk price first Okay how much, okay 100 the usual, 100 No cool down, ima this thing is an album 2shotz no be today wey we start business now I know now Take 100 kam fu this thing Nna mba 120, make it 120 Okay okay, na because say you be my person You know say whenever I come here You dey always bring am straight to me You be my person Okay oya 120 Okay see the money, oya take Eh hen, ha, I hope say e complete oh Count am, count am E complete sha E complete count am E complete, e complete Oya wey the CD Ah ah you are always in a Wey the CD Eh hen eh thank you I go see you guys later Eh okay, later, bye bye Eh bye bye Ah ah, wait 2shotz, 2shotz Come, come, come Bia, bia, bia , wetin happen What is this now Eh, what is what I think you say na your new album now Na my new album (which one is this) This is my new album Which dirty new album No be this album wey we don dey sell here since See am as it full my shelf 4,000 copies E no dey even move sef Nna No no no no problem, nna Give me my money first Wait which money Give me my money first 2shotz Chelu kam hulugodi that your shelf Give me, how you take get my album 2shotz you won do me 419 No na you dey do me 419 Me dey do you 419 how I never release my album you don get am How you take get am (wetin you dey talk) Album wey they sell every where You be pirate oh Pirate wetin we dey for sea (Nna cool down) Nna give me my money Nna I no give you Mmmm eh Nna bring this my money Eh are you mad Eh see this guy I go kill you Eh ole
Rate this song
0/5.0 - 0 Ratings
Loading comments...