Carry Am Go

Album cover art for "Carry Am Go" by 2Shotz

2Shotz - Pop

Carry Am Go

2 Plays

Duration: 3:35

View ArtistView Album

Lyrics

When I dey primary five, I get one friend He no dey to dey class, him no just send You see, Emeka no know book but For class everybody dey wonder how him take dey pass One day e get lecture wey Emeka dey dere Him just dey concentrate like say him mind dey there For where na gimmicks, make we take no fear The boy just dey stratеgies some skills and ideas You don see two еyes dey offload your hand bag Wey person for hand con dey find your school bag Dey follow you dey argue on top am dey brag Ah ah na your own no get label for the tag Shut up my friend, how you take know If I finish with you na your blood go dey flow Bros a beg now, a beg no be so In fact when I take the bag I no know Thief my guy bag talk say him no know Thief ole carry am go You say na your first time abi no be so Thief ole carry am go When you hear bring tyre, your eyes come clear Thief ole carry am go Carry gun, carry knife, only you ney dey fear Thief ole carry am go See this man self, see am he pack for office You dey form oga, why all your people them dey hiss Na pen you dey take do magical tricks You ney dey touch money but money go dey miss Your five account them don full for swiss You dey chop and you think say them no go notice Wetin you dey do bad, and you know this You say I am smart and you are a novice Na true you talk but, na thief be your work When your hear bring tyre, make you no shock Your job na with tie and corporate knocks Agbada or kaftan aso and rock Na this won we dey call thief with style Chop alone and close the file Everyday empty promises go dey pile It is not my fault my brother but mean while Embezzled money talk say him no know Thief ole carry am go You say na your first time abi no be so Thief ole carry am go When you hear bring tyre, your eyes come clear Thief ole carry am go Carry gun, carry knife, only you ney dey fear Thief ole carry am go Your song never comot but e don dey Alaba As you sing finish them go carry am waka E go con plenty like cloths for Yaba E don dey go platinum but my pocket is flatter Na my own sweat them dey use make dough See, this MC's thief my flow Put my life saving con carry am go Bring tyre, fuel, matches Oh no Pirate my CD talk say him no know Thief ole carry am go You say na your first time abi no be so Thief ole carry am go When you hear bring tyre, your eyes come clear Thief ole carry am go 10,000 copies only you, no dey fear Thief ole, carry am go Carry am go Thief, ole Carry am go Carry am go Thief, ole Carry am go Bring tire Carry am go Thief, ole Carry am go 10,000 copies only you, no dey fear Thief, ole Carry am go Ole, ajibole (2x) Ole, Onyoshi leya , ajibole (repeatedly) Lets dance (Instrumentals) 2shotz umunnamo (Instrumentals)

Rate this song

Rate this song

0/5.0 - 0 Ratings

5
0.0% (0)
4
0.0% (0)
3
0.0% (0)
2
0.0% (0)
1
0.0% (0)

Loading comments...

Credits

Credits Not Found