Odeshi

Lyrics
I dey my own for class jegeli This agbaya enter class And him built heavily Definitely, ehn This guy grab men, no doubt When he pull shirt na so the whole class just shout Yeb, yeba, yeba Some use window cut out Even my teacher respect em self Just close mouth The bobo come short well well like small stout With characteristics of a well brought up Lagos tout I no dey owe the guy but my guy tight sha My men dey tell me otherwise 2shotz you no go ja My pastor say My son thou shall not fear When hot piss fill my bladder as my guy near Boy you no dey yan where I dey Misbehave where I dey But now you don dey pull grounds this years wey I dey See this small boy sef Rant with you no go tey Na one blow, you going straight Wey you die, you don ah You think say na the gym wey you dey gym Be your advantage You never hear of small boy lepa wey dey rampage My guy cool down You never hear of David and goliath The ant and the elephant Make we no go into that Some people get their power for different settings Some na from their big mouth Dem dey use run things Some things dey wey we no suppose do brag for So therefore behave yourself Wagbon Bia nwoke iche ni siri ike Odeshi My guy you think say you strong Odeshi Nanya take your time Mind yourself, one blow And your blood go dey flow Odeshi Bia nwoke iche ni siri ike Odeshi My guy you think say you strong Odeshi Nanya take your time Mind yourself, one blow And your blood go dey flow When man fall down No be the end of en life Eh stand well well when person won chook you knife Ah ah, I look left, I look right My liver fail me Na only me dey here And I fit loose this fight You won try me ehn You won try your father Today I go show you say khaki no be leather The guy hold me for throat Hold me for trouser I begin beg for Yoruba, and igbo and hausa The sweat wey I sweat fit full one bucket My eyes don red nearly fall from en socket Pow, one for head Pow, one for chest See me wey dey talk dey fall My liver rest People wey dey pass come dey help me beg the guy Dem be just dey gather See en blow one for eye Everybody clear Leave us for there Oh boy you're on your own oh Ah ah this is not fair Na my phone don miss And I dey very piss I look at this guy ah ah What the hell is this I give am blow for face But en still hold my waist This guy too strong but en no get crase I look round, around I see sand for ground I took me a hand full And threw it at his face Yay my eye, yay my eye If I cath you my guy you don die Catch who, catch who Shey na me, shey na me You don gock am, you don gock am Terribly As I see say the sight don dey briefly impaired I break bottle for en head Bia nwoke iche ni siri ike Odeshi My guy you think say you strong Odeshi Nanya take your time Mind yourself, one blow And your blood go dey flow Odeshi Bia nwoke iche ni siri ike Odeshi My guy you think say you strong Odeshi Nanya take your time Mind yourself, one blow And your blood go dey flow Odeshi Anyi abiala bia k'anyi gawa Eh 2shotz umuunnamo (4x)
Rate this song
0/5.0 - 0 Ratings
Loading comments...