Lamentation (Interlude)

Lyrics
Trybe records 2Shotz My brother which kind nonsense be this The name Nigeria sef Dey backfire You no fit get common garri For five naira For poor man to chop now men Omo I tire For junction na so so shandi police dey collect Agbero dem dem don take style li picking pocket Na so dem eye balls go dey shine For them sockets And if you no drop belunge for them Na heavy baket Oya my friend pack your car Quick quick Where your license or your 20 naira rogеr I no send you if your papa na ex-soldier Na my salary govеrnment dem use Dey grease them shoulder Na so I drop money for 10 more police men Before I count ten I drop everything I earn Even the small salary wey I get from trybes men Na only God go punish all of them Amen
Rate this song
0/5.0 - 0 Ratings
Loading comments...