Lagos Life

Lyrics
Everybody won come Lagos make money Dense population see crowd for oshodi Every day for lagos na wahala If e no be riot Na petrol palava Money miss road on different occasions One milina, several imitations Aba na the source, lagos na the market Wetin dey the inside No be wetin dey the packet If you no get sense dem go just gbawunlogu Every business man won gba inyetogu Plenty stress, very little progress All the hustlе and bustle has a negative еffect Na dirty dirty full the city What of the ladies dem be ashi Plenty dey broke Very little dey flashy When they match with lagos Ehn, you better fashi Lagos life na stress oh (8x) To get money na crime You dey guilty as charged Boys dey try hustle money Dem duty at large Na so the money scarce Men eyawh Na only God fit save man from this wahala Monday morning for Lagos en never change You fit flenge for weekend But no just try am again A form of mass movement moluwe If you no sabi hang Danfo dey there Officer for check point na like 20 bucks Traffic na die my guy bon hold up Egoye no dey Men the heat punish Thank God for pur water so we go try manage Watch conductor too dey cry All na shakara Miologe Agbero boys still go dey tag If you won form levels You go try follow cab Otherwise na okada or saps Lagos life na stress oh (8x) No city get gbedu up to this level No try oh we dey gayve oh Happening city omo we dey gon Na always busy, we dey play gon Everybody just dey wait for the weekend Ogbe na Friday I fit go on free *** Waka to the club, scoping for chicken Yan up small till the party begin You go get up You go start sipping What a jam, of course na my record When my city spot, on top, on top How we dey rock Nonstop, non stop Our guys nkor baffed up, baffed up Our girls nkor, shey you no trust L A G O S, best in the west Blessed to impress Don't test with the rest Lagos life na stress oh (8x) (Instrumentals) Lagos life na stress oh (4x)
Rate this song
0/5.0 - 0 Ratings
Loading comments...