Story Time

Album cover art for "Story Time" by Falz

Falz - Rap

Story Time

1 Plays

Duration: 5:46

View Artist

Lyrics

See you for leave me make I do am acappella Who wan stop my pena I go do am that panenka Oya check am Omo Folarin the born skiller Them don know say the boy go be great Okunrin meta Them say Lion no dey born goat Lord knows, this one go still fulfill hin purpose One day But now I'm quiet in the motto My Maale don dey boil o I know that I'm in trouble Me no just like school really I fuck up I know say she go discipline me Out of 54 I carry 53 My Maale cry pieces I no just like the feeling But the young shall grow Before una know, I get double promotion sha Stop am o, no be say I no know book Na som5thing man go go through Food wey dey sweet dey slow cook I pr5fer playing boju boju Cute dribbles, word puzzles to Sudoku Arithmetic my nemesis I have no clue If e don dey wan resemble science me I no do Oga shebi I told you. I dey ball! I'm like JayJay Okocha, when I dribble men dey fall T� n b� m�ra mo le replay USA 94 I get the talent and the drive, I go make am e sure If I just try to keep am up, balance with my report card Slow down! Come back Yoruba Parent no too dey raise footballer You go go university, you go read Lawyer You go be like your father, you no fit to dodge am I con dey reason am say okay this football P Omo I go really like play am o Like professionally bro. For real But school though, do I really have to go? Can I just dodge the P I no dodge am o. I don dey big up I dey feel say all my days of adolescence e don come and go Voice getting deeper, couldn't come any quicker That thing wey I start I go finish, I no be quitter This thing I dey do like small hobby e don dey ginger When I dey SS1, na there I start dey perform Shout out to my boy teddy, �un l� j� kin b��r� gaan We Dey for Dorm, we Dey hear tribe's men plenty nonsense We listen listen till we know rap was what we wanted How I take dey run am, walahi k� s�mo b�� School boys wan play for variety show call your friends I enter Uni 16 This United Kingdom e too cold for pesin pikin New schedule no be routine Balancing no time I find my circle This place no be my father land I for try dey careful Rap wey I dey do like play, I for up the level Enter studio proper K� s�ni t� m�la I fit go throw double 6, life na Ludo run am Na then Aboki call me say my talent yapa Make we start our own label, kaa le plan eh dada Baba buzz me on some bro, let's let's try and be business smart with this P Look. This is how them Jay Z started bro They started in one room, they formed a company and... I was like bro, which one be all this... Me I just wan make music but, no yawa, let's go We plan am well, We start afresh I start dey do show here and there, money no matter first I enter law school for Abuja then, my ex girl we broke up since my 2nd year But now I no dey find distraction I'm just tryna make it in this game I need a platform Don't wanna break your heart so baby I go beg your pardon Mi � l� f�n omo n� many promise, kin w� f� l� s� lor Don't wanna take on what I know that I can't really fathom You no happy with my decision then cry me a gallon I waka waka, I go TV, I go radio drop my CD Shakara the mixtape na the first time wey them go feel me And then cool party, 1,2,3 All this time I no let lecturers to dey confuse me 2012 I was called to bar, before I turned 22 I no need to reason many before I stand for the truth It's the only way I know What I saw my father do What my mama says is right What seems rational too 2013 I met Femi soro My guy say He see the dream, he go vibe for the culture And all three musketeers gaan l� w� Lon� The day baba God go say him must to show him color If we no die for road, baba nothing go kill us In all versions of this story, no one where we give up Tryna convince our folks that the hustle is serious Then we hit the first million 1 million naira... eh God They say there's a private wedding It's in Abuja It's happening this weekend Bro I'm there already 2014 I drop my first album now you know I'm a wazzup guy Same time I dey catch banter With Foladele Folakemi I no plan that Talk one small tin, e cause big laughter I Talk another one, everybody scatter Sometin wey dey body since, na this one you dey chop? I go taku for these streets Now I don dey be like jester I dey worry for secret But by 2015, omo stories that touch was a hit Shout out Sesan Salami Omo le la kor� s� When I met Simi na these three people committee, wey give birth to Ahemistry Are you guys dating? What's going on here This this looks like there's some romance brewing Can you guys tell us what's...? I start dey write my film story for Jenifa's Diary This year mo s�r� gba AMVCA kan d�n� Same year, I win BET, niggas Dey beef me Ab�nib� y�t� si ability 2017, I dropped 27 just before I turned 27 2018, I just wan freestyle about the state of the nation, this is Nigeria 2019, they tagged me stubborn, k�nni mo she, mo s�r� drop moral instruction That one no be just title, my mic e turn rifle I hala but, I hala boj, make e no cause fight too Om� D gb�n� feli feli, e m� pe k� s�nik�ni Nothing wey for fit prepare me, lockdown 2020 Corona virus hold the world But that one sef no mean say Bop Daddy no go rock But by the time we go return, everything don change from that wey we know before October pulled us out to the streets, threw me the mantle Showed me if we really all came together, this what we can do RIP to those that we lost, broke me to shambles I know say ups go still meet down for where them trample 2022 brought bad, syphilis slept on But them go still come back 2023, was surgey, na the same ball I dey play, but I'm now 33 2024, I dropped a treat, quick 6 track and this the one that comes before the feast Red carpet fresh, kill em with the swag when I step out in that mad on som' And if they ask you what's next, say the feast is here Let them know I'm far from done!

Rate this song

Rate this song

0/5.0 - 0 Ratings

5
0.0% (0)
4
0.0% (0)
3
0.0% (0)
2
0.0% (0)
1
0.0% (0)

Loading comments...

Credits

Writers
  • Oluwatobi Ayokunle Omidiji
  • Falz