Hypocrite

Falz & Demmie Vee - Rap
Hypocrite
34.3K Plays
Lyrics
[Pre-Chorus: Demmie Vee] People just dey do like say they no dey shit People just dey do like say they no dey breathe o People just dey do like say they get superpower People just dey do like say they no dey weak o Oh! Nobody wan dey sow where e no dey reap o [Chorus: Demmie Vee] Everybody is a motherfucking hypocrite oh yeah yeah Everybody is a motherfucking hypocrite oh oh na Everybody is a motherfucking hypocrite oh [Verse 1 – Falz] People just dey do like say na dem be Jesus People so wicked but they so religious Who dey calculate E no dey show the figures Who dey demonstrate wey dey run leave us People too complain but dey fear to speak up You don't want to die but nothing to live for Christian and corrupt no suppose be mixture Real musulumi e no suppose dey thief jor Real talk no be fight rara Everybody get fault for inside matter We dey talk human right We no respect am Who are we to crucify the homosexuals? Most of una don dey involved from time But no be anybody business who you wan climb You dey form gentle man when we dey with you But you go still go home beat your wife to stupor [Pre-Chorus: Demmie Vee] People just dey do like say they no dey shit People just dey do like say they no dey breathe o People just dey do like say they get superpower People just dey do like say they no dey weak o Oh! Nobody wan dey sow where e no dey reap o [Chorus: Demmie Vee] Everybody is a motherfucking hypocrite oh yeah yeah Everybody is a motherfucking hypocrite oh oh na Everybody is a motherfucking hypocrite oh [Verse 2: Falz] Pastor wey dey do like say e no be sinner See the speck in your eye no dey point finger What about the really greedy politician Acting like he really care for the layman And what about even you voters, wey dey act like say you only see two jokers Recycle the same corrupt men, later you complain you say you hate the government And the fake prophet, some dey for convent With under-aged boys, wey they make boyfriend And you claim consent when you messing with a minor Some say na devil box so no telly for their parlour Ehn ehn, because she no be virgin you no meet am well But the one wey tie scarf you no give am hell Oh you say you no dey smoke you no dey drink liquor But your heart e dey evil shey you see the picture [Pre-Chorus: Demmie Vee] People just dey do like say dem no dey shit People just dey do like say dem no dey breathe o People just dey do like say they get superpower People just dey do like say dem no dey weak o Oh! Nobody wan dey sow where e no dey reap o [Chorus: Demmie Vee] Everybody is a motherfucking hypocrite oh yeah yeah Everybody is a motherfucking hypocrite oh oh na Everybody is a motherfucking hypocrite oh Of course I know truth is bitter Bitter gidi gan pass bitter leaf What is the essence of debating When we know the truth in our mind Why you con dey do like say you no shit Why you con dey do like say you no dey love o We no fit be the same Everybody is a mother fucking hypocrite oh
Rate this song
0/5.0 - 0 Ratings
Loading comments...
Credits
- Writers
- Demmie Vee
- Falz