Hate, Pt. 2

Lyrics
Oya, let's go, let's go, let's go Boy you talk say you hate E.M.E No be E.M.E music you dey listen to for this one? Na E.M.E music be this Yes now Ehn, na my sister go don put am inside I dey try check the thing since sef Why you no go check am? The CD player don spoil That's why I just leave am there Okay, but you dey nod your head to the music I just say catch you now you dey nod your head I no nod my head I get neck problem My doctor say make I dey nod head Every time wey the thing dey pain me Say thе pain go dey go Men But you're nodding your hеad to the beat The beat? Yes No him say make I dey nod am to any beat wey I hear Say he go make dey rhythm Okay, why you no off the radio? Me? Off the radio? Look, see ehn, no dey ask me No dey ask me this kind thing As I dey hear this song I dey hear this song so I wan don go jam person now So you dey annoy me Because of music you go jam person I hate this E.M.E people I hate them I no just like them You sef why you dey ask me question? Why you dey ask me question? You know what? I wan You know, comot for my motor Comot for my motor Comot from this motor Oh boy na me na Na me get this motor Na your motor? Yes! Ehn ehn You know what I wan comot I wan commot from this motor Just pack In short, na me dey drive sef Make I pack
Rate this song
0/5.0 - 0 Ratings
Loading comments...
Credits
- Writers
- BasketMouth