How Far

Falz & Sir Dauda - Rap
How Far
1 Plays
Lyrics
Someone told me long ago say life go better Still we dey under the weather Someone tell me how far And since 1960, we don dey waka And even now sef we still dey the matter How far? How far? I pray tell me how far? Ah, why? Why life for here just dey somehow? Why some people no fit get food when dem wan chow? Yet some people fit land jets for them compound, ha Why that money no fit come round? So when I need me sef I'll have some, on ground Why children no fit go school, why dem dey unsound? Why dem no fit fulfill their dreams as dem for like to? And this rate of poverty lo c� high j� (How far?) Ha, dem say oil dey, o y� k� low� g�an But our leaders dem wise pass Solomon Dem mismanage everything, w�n k�n d�'l� r� Hey, giant of Africa, �w�n g�an ti w� c�b� Poor man dey hustle, he dey find work But the elites dey okay, dem dey buy stock All man see, me sef no be say I shock But I get questions, I need follow some guys talk Someone told me long ago say life go better Still we dey under the weather Someone tell me how far And since 1960, we don dey waka And even now sef we still dey the matter How far? Una tell me, how far? Abeg tell me how far? Someone explain to me, abeg 'Cause I no know how To dey blow up towns don dey in vogue now Abeg gimme the gist, gimme the load down Shey na like this things suppose go down? She don turn 53 but look am head to toe Wetin she don achieve, wetin she get to show? We still no get light, we still dey use gen We still need more schools for the children (How far?) Area boys plenty, dem no see job Why dem no go carry gun and begin rob? Meanwhile naija police, dem still dey beg for pay Dem need deliverance, carry dem come pray We don dey wait make things change but no show We no progress, be like we dey for go slow I for no talk like this if bomb no blow If people no fight, if blood no flow Someone told me long ago say life go better Still we dey under the weather Someone tell me how far And since 1960, we don dey waka And even now sef we still dey the matter How far? Una tell me, how far? Abeg tell me how far? Crystal clear, everybody dey see My people gb�d�r�, my people r�ti Some people don go, n�tor� t'�mi and n�tor� ti e, ah So if fire no dey, walahi ko le si a fame Mo ni crystal clear, everybody dey see My people gb�d�r�, my people r�ti Some people don give up, sef 'Cause when we dey primary one, dem say make we lead and not to follow Say when we grow up, we go be leaders of tomorrow Shey tomorrow go come? Shey dem go leave us, when? 'Cause the same set of people wey dey lead us then Are still the same damn people wey dey lead us, mehn! Dem say we go write the future, dem no give us pen Give it up for VIPs, dem be our problem Vagabonds in power, as Fela call them But change go come, yeah, right, I know Dem say dem dey lead but dem just dey do us wayo Hunger dey waya guys for here, sotey their eyes red Hunger show this guy pepper, sotey the guy shed O chi wa loj� t�t� all day, dey find bread Na only hustle he know, na struggle dey inside him head Guys try hard, dem dey hold tight for here But condition's too harsh, e cold pass oye Someone told me long ago say life go better Still we dey under the weather Someone tell me how far And since 1960, we don dey waka And even now sef we still dey the matter How far? Una tell me, how far? Abeg tell me how far?
Rate this song
0/5.0 - 0 Ratings
Loading comments...
Credits
- Writers
- Falz
- Sir Dauda