Industry Nite (Refix)

Lyrics
Na if you hear say I die say person shoot me Will you cry or say na wetin my mouth put me What if you hear say na one robbery when I go Cause I don tire for underground I just wan blow Shoot videos wen bad like them daddy yo Put am for Trace Hip TV and MTV yo Oliru o Sunday scatter G twelve bar Enter Cotonou go buy like 20m car Na in those days these talents fit blow you Nowadays without money nobody wan know you Presenters with their share even DJ's too 100k each which show these upcoming dey do Get the nerve say Erigga shoot with Clearance Under this recession how much dey the balance The industry for Nigeria be like campaign Share the money PDP if you wan reign E be like say nah endorsement be the new swag Even if money no follow you fit take am brag Label dey spend big money for artiste head But the artiste no go show many artiste dead Now for you too live the label be like like concrete work Very hard because of wetin dem don spend on top Cos your boss dey expect hundred million After all this song blow were the hundred million My label don cast e don go to G back Word on the street dem collect the house and jeep back Same girls when dey dance when dey hear your beat Na dey take you do yeye when they hear your gist Welcome to industry nite Na you dem dey host today you go perform right For your mind all these men when dey here love you But when dey reach their house dem go judge you Welcome to industry nite Na you dem dey host today you go perform right For your mind all these men when dey here love you But when dey reach there various houses dem go judge you I swear down mehn the fake industry we have right here mehn Fake likes fake followers fake views mehn But any how sha l can't just leave you stranded So l gat to bring in the Real you know what am saying A trip to the south you no need visa King of the south to your door like Domino Pizza The way my rap big I dey fear make you no drown One stop to my money long pass devil gown A trip to the south EP use your eyes listen And mouth look better learn the industry is missing Rappers dey fear dem no believe say I go blow one day Heart dey beat anyhow like who follow one way If na beef you dey find I shade am like suya Salamaleku my kalagbero reply puya Tell your producer orhh Use eim number text you Say better beef dey you come studio we mess you Na me na own the throne you just dey stone the throne Na street catry am give me I no fit bone the throne My teacher tell me say na army gun go shoot me die But instead na Clearance dey shoot me guy The day anonymous call me I dey jungle dey smoke Sign contract I never start industry don dey smoke I don big pass who dey write na straight from my head Commot your leg for wire Warri say abegg
Rate this song
0/5.0 - 0 Ratings
Loading comments...