Hate, Pt. 3

Album cover art for "Hate, Pt. 3" by BasketMouth

BasketMouth - Non-Music, Nigerian Pidgin

Hate, Pt. 3

0 Plays

View ArtistView Album

Lyrics

Won di ge ge ge, I'm the baddest boy De de de, I'm the baddest boy You see now No be EME music you dey horn I just hear you now! Na wetin you dey horn? Baddest Boy Baddest Boy? My brother, na me get this song Na song wey I don write since 1992 Na make me hate those guys dem steal my, my, my, my song You wrote Baddest Boy in '92? '92 since 1992 You know since when I don dey write music Before them sign, wetin dem dey talk say, dem don sign collaboration with eh, Akon Make them rest hear me They no get anything Wetin dem sign? Me! Na me first sign Na when dem see me sign So why we no see you with Akon? Na autograph he sign but he sign something What? So, say autograph and audio a the same thing? My brother signature na signature Leave that thing Dem dey bow for my side As they see me say Akon sign my autograph They come go sign deal with am I hate those people! So na wetin dey make you vex? In join, they steal my beat They steal my lyrics I'm the bad Na me be the bad boy na I'm the baddest boy They just Who bad? Okay, who bad for all of them? Na Skales? Na Wizkid? Na Banky? They too fresh to bad I hear say them get some new people Ah, Shaydee new Like Niyola Make those girls go rest! Wetin Niyola bad? Where she wan bad go? Shey wetin she wan do? Them no bad anything abeg You know wetin dey ehn? I no wan horn again! No dey ask me again No dey ask me any question! Who you be sef?! Who you be wey dey ask me question?! You know what I hate you sef! Comot here!

Rate this song

Rate this song

0/5.0 - 0 Ratings

5
0.0% (0)
4
0.0% (0)
3
0.0% (0)
2
0.0% (0)
1
0.0% (0)

Loading comments...

Credits

Writers
  • BasketMouth