Beasts Of No Nation

Lyrics
Ah, let's get now into another underground spiritual game Just go dey help me dey answer, you go dey say, "Aya kata", oh ya O feshe lu, Aya kata O feshe gban, Aya kata (2x) O feshe wan, Aya kata O feshe gben, Aya kata Aya kata Aya Koto Aya Kiti Aya Kutu O feshe lu, Aya kata O feshe gban, Aya kata (2x) Ohhhhh Basket mouth wan start to leak again oh Basket mouth wan open mouth again oh Abi you don forget say I sing ee-oh Basket mouth wan open mouth again oh I sing-i say, I go open my mouth like basket oh, ma lanu bi apere Basket mouth wan open mouth again oh (2x) Basket mouth wan start to leak again oh Basket mouth wan open mouth again oh Fela, wetin you go sing about? Dem go worry me (3x) Dem go worry me, worry me worry, worry, worry, worry Dem go worry me Dey want make I sing about prison Dem go worry me Dem go worry me, worry me, worry, worry all over da town Dem go worry me Dey want to know about prison life Dem go worry me Dem go worry me, worry me, worry, worry all over da town Dem go worry me Dey want make I sing about prison Dem go worry me Dem go worry me, worry me, worry, worry, worry, worry, worry, worry Dem go worry me Dey want know about prison life Dem go worry me, worry me, worry, worry, worry, worry, worry, worry Fela, wetin you go sing about? Dem go worry me Dem go worry me, worry me, worry, worry, worry, worry Dem go worry me The time wey I dey for prison, I call am inside world The time wey I dey outside prison, I call am outside world Na craze world, no be outside world Craze world No be outside the police dey Craze world No be outside the soldier dey Craze world No be outside the court dem dey Craze world No be outside the magistrate dey Craze world No be outside the judge dem dey Craze world Na craze world be dat Craze world No be outside Buhari dey Craze world Na craze man be dat Craze world Animal in craze man skin-i Craze world Na craze world be dat Craze world No be outside Idiagbon dey Craze world Na craze man be dat Craze world Animal in craze man skin-i Craze world Na craze world be dat Craze world No be outside dem find me guilty Craze world No be outside dem jail me five years Craze world I no do nothing Craze world No be outside dem judge dey beg ee-o Craze world Na craze world be dat oh, Na craze world be dat Craze world No be outside dem kill dem students Craze world Soweto, Zaria, and Ife Craze world Na craze world be dat, ee-oh Craze world Na craze world be dat Craze world No be outside all dis dey happen Craze world Na craze world be dat, ee-oh Craze world Na craze world be dat, ee-oh Craze world Na craze world be dat, ee-oh Craze world Na craze world be dat, ee-oh Craze world Na craze world be dat, ee-oh Craze world Make you hear this one War against indiscipline-ee oh Na Nigerian government, ee-oh Dem dey talk ee-oh My people are useless, my people are senseless, my people are indiscipline Na Nigerian government ee-oh Dem dey talk be dat My people are useless, my people are senseless, my people are indiscipline I never hear dat before oh Make government talkee-oh My people are useless, my people are senseless, my people are indiscipline Na Nigerian governmentee-oh Dem dey talk be dat Which kind talk be dat oh? Na Craze talk be dat ee-oh Na animal talk be dat oh Na animal talk be dat oh [Chorus] Many leaders as you see dem Na different disguise dem dey hol' Animal in human skin Animal I put u tie oh Animal I wear agbada Animal I put u suit u (2x) These disguisy leaders ee-oh, na wa for dem Dem hold meeting everywhere, dem reach America (2x) Dem call the place United Nations Hear oh, another animal talk Wetin united inside United Nations? Who & who unite for United Nations? No be there Thatcher & Argentina dey? No be there Reagan & Libya dey? Israel versus Lebanon Iran-i-oh versus Iraq-i East-West Block versus West Block East No be there dem dey oh United Nations? Dis "united" United Nations One veto vote is equal to 92...or more, or more Which kind sense be dat? Na animal sense (2x) [Chorus] Them go hold meeting oh, Them go start yab human beings Animal talk don start again Dash dem human rights (2x) How animal go know say dem no born me as slave? How animal go know say slave trade don pass? And, they wan dash us human rights Animal must talk to human beings Give them human rights Abegi oh, make you hear me well-u well Abegi oh, make you hear me very well Human rights na my property!!! So therefore, you can't dash me my property Human rights na my property Dem wan dash us human rights Some people say why I dey talk like dis? No be talk like dis dem take to carry me go prisonee-oh No be me dey talk, na Prime Minister Botha dey talkee-oh (2x) Him say, this uprising will bring out the beast in us This uprising will bring out the beast in us (3x) Ke ji keke: my argument Botha na friend to Thatcher & Reagan Botha na friend to some other leaders too And together dem wan dash us human rights Animal wan dash us human rights Animal can't dash me human rights Animal can't dash us human rights [Chorus] Beasts of no nation, Egbe-ke-gbe na bad society Beasts of no nation, Egbe-ke-gbe Beasts of no nation, oturu gbe-ke [Chorus] Beasts of no nation, Egbe-ke-gbe Beasts of no nation, oturu gbe-ke