My Head My Belle

Lyrics
Chorus My belle o, my head o (4x) Verse 1: Mommy don't cry Imma make sure you say we no die Imma go hussle and we go try Hunger hook man for neck, shey na bowtie Whatever it takes, me I no shy If na heaven food dey, make we go sky E better now make I sit down, make I no try I go even buy ticket make we both fly Mama, if it means say, make I turn slave, kuta kente Anything just to make clean pay You never see food chop since Wednesday Make I wash car, sell gala, shine shoe Shey na work, anything I no mind do I go do better work, even times two Cos it's not easy, it's not easy, it's not easy (Repeat chorus) Verse 2 Chale, no vex Anything for your boys, make we go flex No work make we do, so no cheques Aaah We sef wan rock Rolex Do something for your boys, we are loyal You be king, you be chief, you be royal Alaiye you go scatter them total International star, no be local Eh ha If we get work, wey go bring better food make we take chop No be road we for stand, we for dey shop If for say things connect like we network If for say school fees dey, we for dey class You sef no say warri no dey carry last But as things dey na, we no fit chop grass At all at all, nah him bad pass (Repeat chorus) Bridge: Naija people, just surviving Okada riding, police bribing Pastor preaching, pay your tithings School fees paying, food providing Impure water, no electric So much traffic, see the life is hectic Sewage leaking, there's air pollution Rats are everywhere, no solution Roads with potholes, people dying All the bastards politicians lying University, degree pursuing Fuel scarcity, people queuing Black market, petrol impurity Armed robbery, there's no security Fuel prices, Niger delta Religious crisis, then no shelter Verse 3 Oga stop there Abi u never see road block here Na we be the police search and stop here If you wan pass son gotta drop here U no dey see gun abi u no well If you form actor, u go go cell See behind counter, no be hotel You go do 3 nights before u go bail But if you want move You sef know wetin you suppose do Do am quick quick make I no expose you Nyem something make I hold or I'll hold you Hey Sergeant Collins, make you come check Search am quick, search him bag and him pocket Any exhibit wey we come get Then alarm go blow on una trumpet (Repeat chorus till fade)
Rate this song
0/5.0 - 0 Ratings
Loading comments...
Credits
- Writers
- M.I Abaga