COCAINA PATIENT

Lyrics
[Verse 1] Police don block the motor make nobody come down We been sit down outside dey argue front of we compound About Ronaldo, Messi money when we hear the gun shot We feel say na play till we stroll reach Cynthia mama shop 3 boys mask up kporkpor use them lie ground Be like film for we eye na better machine na e dem carry Use police run better race, but as dem reach that sharp turn Kuti play follow them, who drive na bros Batare Baby Benz - Sharp onе. Them spray the top black Beigе interior, this na when that motor newly come Na one ljaw man them go rob, dem follow am from bank E just dey go from [?], Shell pay am millions Them say na one person for plaza na e give them the line According to who go station wen dey admit the crime Area don gather for snooker board around nine dey judge Say Emma fuck up, big man pikin. Which money e dey find? Around 9 you go see guy man don powder nose No be say na make up artist if you know, you know Eye dey red through window dey shele people phone Wan fire ice as I dey talk na my shoe Dey him leg [Chorus] Cocaina patient Cocaina patient Trouser dey ground belt Dey waist Dey talk plenty Cocaina student [Verse 2] I Dey my snooker board dey smoke, you carry problem come My people no [?] How your matter be? Na money matter we dey talk and u know say head burn No worry blood I dey with you, leave everything for me Swipe right, swipe left na you get choice Anyhow you wan live your life, na you get voice You no fit dey motor with me dey say you Dey your lane Na the same place we two Dey go no use your life do toys When gen off everybody go remove their phone Carry their charger Waka - oko na so life be Carry your passport no be only stand alone For cofffin na only you - oko use ur IP [Chorus] Cocaina patient Cocaina patient Trouser dey ground belt Dey waist Dey talk plenty Cocaina student
Rate this song
0/5.0 - 0 Ratings
Loading comments...
Credits
- Writers
- Erigga