My Car

Lyrics
[Intro] Tetu, where you dey go?, wetin you dey find? Why you dey ask me that kind question Say where I dey go Where I dey go?, I dey come [Chorus] You don hit my car, oyinbo repete As you don bash my car, gbese repete Tell me, you don hit my car, oyinbo repete As you don bash my car, gbese repete [Verse 1] Wetin you dey find?, where you dey go? As I dey waka dey go like so Me I'm looking for this paddy This paddy owe me plenty money Dem tell me say hum dey ikoyu Me I get yidis for one party Seri Paddy yen, ofe pa mi Today na today, no time for story Tinba dele re, ti n gba mu He must ro pay me all the money I come reach him say, I come see say People gather dey just dey cry I try to know wetin cause the cry They tell me say my paddy don pai As I con dey go back to my house I come meet small hold up for road The next thing wey I hear for my back Na one scratch from another car Ehn, ehn [Chorus: Tony Tetuila] You don hit my car, oyinbo repete As you don bash my car, gbese repete Tell me, you don hit my car, oyinbo repete As you don bash my car, gbese repete [Verse 2: Tony Tetuila, Eedris Abdulkareem] See, me see trouble ooh, another gbese Dead body no dey pay person money Another paddy don dey bash my car Today na today, no time for story Ah, Eedris, na you, see wahala "Heyo, what's up, Tony, what's up man Ebe long time, we no see, what's up man" "Oh boy, stop that yarn o, wetin be what's up You bash my car, you dey tell me what's up Shey na what's up I go use spray my car, abeg pay me my money" Police con come dey measure the line They say make I no worry, everything go be fine They come bring papers say I make sign I sign my own, Eedris sign im own I con dey whether who get the fault They say na my paddy get the fault o I pack my car, see trouble Yanga dey sleep, trouble come wake am He, he [Chorus] You don hit my car, oyinbo repete As you don bash my car, gbese repete Tell me, you don hit my car, oyinbo repete As you don bash my car, gbese repete [Bridge: Pastor Goody Goody] Huhh Somebody o, somebody wey You don kissin ni, bobon kolo Shey na girigiri you dey take drive car Shey it's good Somebody wey were, bobon kolo fit kolo Begin dey drive car ka kai kai Don kolo, girigiri [Verse 3: Tony Tetuila] Another wahala to carry for head Money no dey pocket for man to spend One of my paddy wey dey owe me money I reach im house, they say he don pai Another one don dey bash my car Wetin I go do, e no get money I con think say this stress no worth am Today be na your own, tomorrow fit be my own I go tell my paddy, make he come dey go Then I try to push my car from road As I push am small, wetin I see Na government car come bash my car Again [Chorus] You don hit my car, oyinbo repete As you don bash my car, gbese repete Tinubu, you don hit my car, oyinbo repete My own don better o, owo repete You don hit my car, oyinbo repete My own don better o, owo repete Tinubu, you don hit my car, oyinbo repete My own don better o, owo repete Tinubu, you don hit my car, oyinbo repete My own don better o, owo repete Tinubu, you don hit my car, oyinbo repete
Rate this song
0/5.0 - 0 Ratings
Loading comments...