Illusions

Album cover art for "Illusions" by Brymo

Brymo - Pop, Folk

Illusions

0 Plays

Duration: 5:39

View Artist

Lyrics

You carry boyi go yonder, you say he no go oh Slavers boku round town hin brother tell am oh Stand for your ground, make you no hurry follow go Them dey sell people troway, my brother no go oh The people them wey go river them never return oh Them say na mami water carry everybody go oh For full moon, papa go farm he never return oh, them say na the forest carry am swallow oh Listen boyi, life no balance at all oh You go place you no know, you no go return oh Boyi feeling true, him heart dey beat for the road oh Him fate na to follow them, follow journey go Ah ah ah Wetin I think I become ah Ah ah ah Na illusion them dey sell you so Boyi look forth, him look out, no other place to go oh He carry him few belongings, reluctantly follow go For this life we dey, the things you do you know oh E better to go reach the place find how e dey oh I talk am, I shout am boyi still dey travel go Na destiny dey push man where him dey go ah He try am, he fight am, urge strong no be small The tori e dey the place where him dey go ah Ah ah ahhhh Na wetin I think I become Ah ah ahhhh Na illusion dem dey promise you so Oga master no wan know how him pig fat pass people oh He say dem be property, with him dog dem equal oh Boyi clean gun, he shave beard, Oga trust no other He for adopt boyi, but him people hala That night boyi take razor he shave am proper, the way Oga dey like am, no touch him moustache ah Poison for soup, for family and the guys them He slash master throat too from ear to ear ah Ah ah ahhhh Boyi na most wanted for strange country ah Ah ah ah He dey gather soldiers ah From plantations he dey break boys free (Clears throat) Ehn ehn My people The main reason we gather here today, na him concern us now Na there we dey go next Ah today on behalf of the people of the city and the township, the entire tribe and our very very race, we go unveil this statue of boyi We go give our honorable personality himself the scissors to use cut the ribbon For service to humanity and to race and eh we salute you sir We salute you well well, because you really touch our lives, you don change our lives from generation to generation to come Nothing go ever remain the same for us Yes, this statue na the honor of your greatness Thank you

Rate this song

Rate this song

0/5.0 - 0 Ratings

5
0.0% (0)
4
0.0% (0)
3
0.0% (0)
2
0.0% (0)
1
0.0% (0)

Loading comments...

Credits

Writers
  • Brymo